Di man wey chop accuse say e fatally shoot Charlie Kirk don confess to killing di right-wing activist for one message to im roommate, prosecutors don allege, as dem announce seven charges against am.
22-year-old Tyler Robinson, leave one note under one keyboard for im roommate to discover, Utah County Attorney Jeffrey Gray tok. E add say di roommate na di defendant romantic partner.
According to Oga Gray, di note say: "I bin get di opportunity to take out Charlie Kirk, and I go do am."
Di prosecutor also share text messages between di roommates, wey include one wia di defendant allegedly tok say im shoot Kirk bicos im don "get enough of his hatred".
Wia dis foto come from, Reuters
Dis na di full record of series of text messages e exchange wit di alleged gunman on di day of di shooting, wey di roommate submit to investigators.
Robinson: drop wetin you dey do, look under my keyboard.
[Wen di roommate look under di keyboard, one note dey dia wey allegedly read: "I don get di opportunity to take out Charlie Kirk and I go take am."]
Roommate: "What?????????????? You dey joke, right????
Robinson: I still dey ok my love, but I dey stuck for Orem for sometimes. E no go take long, until I reach house, but I need to pick my riffle. To be honest I bin dey hope to keep dis secret till I die of old age. I dey sorry to involve you.
Roommate: No be you do am right????
Robinson: Na me, I dey sorry
Roommate: I tink say dem don catch di pesin?
Robinson: no, dem grab one crazy old dude, dem later interrogate pesin wey wear same cloth like my own. I don plan to grab my rifle from my drop point shortly afta, but dem don shutdown di area. E dey quiet, almost enough to get out, but e get one car wey still dey dia
Roommate: Why?
Robinson: Why I do am?
Roommate: Yeah
Robinson: I don get enough of im hatred. E get some hate wey you no fit just quiet dey look
Robinson: If I fit grab my rifle and nobody see me, area clear be dat wit no evidence. I go try retrieve am again, hopefully dem go don comot for dia. I neva see say dem dey find am
Roommate: How long you don dey plan to do dis tin?
Robinson: a bit ova a week I believe. I fit get close to wia di riffle dey, but e get one police car wey dey parked close to wia e dey. I tink say dem don already clear dat spot, but I no wan risk am
Robinson: I wish say I don go back and carry am as soon as I enta my car…. I dey worried, I no know wetin my old man go do if I no bring back grandpa rifle … I no know if e get serial number, but dem no go trace am to me. I dey worry about prints, I leave am for one bush, wia I change my dress. Time no dey to carry am… I get to leave am and hope say dem no go find prints. how I go take explain give my old man say I don lost di riffle….
Di only tin I drop na di riffle wey I wrap for inside towel…
remember how I bin dey write on di bullets? Di [coded] messages na mostly one big meme, if I see "e notice bulge uwu" on fox new I fit get stroke alright I go leave am, e really [expletive] suck…. judging from today I go say grandpa gun dey work well-well idk.. I tink e buy am for $2k scope;-;
Robinson: delete dis exchange
Robinson: my dad want fotos of di rifle … e say grandpa wan know who get what, di feds don release foto of di gun
Robinson: since trump enta office [my dad] don turn pretty diehard maga.
Robinson: I go turn myself in willingly, one of my neighbours here na deputy for di sheriff.
Robinson: Na only you I dey worry about love
Roommate: Na me worry about you pass
Robinson: no follow media please. no grant any interview or make any comments…. if any police ask you question ask for lawyer and stay silent.
Prosecutors allege say di man wey dey face accuse say e fatally shoot Charlie Kirk confess to killing di right-wing activist for one message to im roommate, as dem announce seven charges against am.
22-year-old Tyler Robinson, leave one note under one keyboard for im roommate to discover, Utah County Attorney Jeffrey Gray tok. E add say di roommate na di defendant romantic partner.
According to Oga Gray, di note say: "I bin get di opportunity to take out Charlie Kirk, and I go do am."
Authorities hold di suspect without bail for one special housing unit for di Utah County Jail.
E make im first court appearance on Tuesday, 16 September, e appear remotely as prosecutors read di seven charges against am.
Di charges na:
Dem also say dem go seek di death penalty ova di shooting of Kirk, wey one single gunshot wey dem fire from one rooftop kill, as e dey tok for one Utah Valley University on Wednesday.
Dem arrest Robinson last week afta one 33-hour manhunt. Di defendant neva ask for plea or confess to police.
Di prosecutor also tok say di accused dey innocent until proven guilty and e go face trial by jury.
E unveil plenty evidence for one news conference on Tuesday, 16 September, wey include di defendant alleged confession and DNA dem see on di trigger of di rifle wey dem reason say di suspect use for di crime.
Oga Gray say dem see di suspect DNA for di trigger of di rifle wey dem use for di shooting.
E also say di suspect father bin suspect say di weapon match one bolt-action rifle wey once belong to di suspect grandfather.
E bin contact di suspect afta di shooting and ask am to send foto of di rifle, but e no reply, Oga Gray tok.
Di defendant also detail im movements afta di shooting for messages e send give im roommate.
Prosecutors say di defendant also dey charged wit witness tampering, bicos e ask im partner to delete dia messages and stay silent if questioned.
© 2025 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.
